ORDERED CHAOS EPISODE 6
*(This Episode is particularly dedicated to Rotr Musah Khalifa....the guy with the sickest playlist I know.... The dude can encourage and also be a brother sha... lol)*
Room 11 A destiny Lodge, Hilltop....
*10:00pm*
*Kizito* : Shit!....That babe go dey vex for me nah...
*Eze* : No oh!....She go build you golden statue for her village...idiot!
*Kizito* : guy, you dey use your brain at all?....if she come nah, you no know say night don reach.... She go claim say she wan sleep here....
*Musa* : Nah the idea be that nah...she tell you say she no calculate am before she call?...
*Kizito* : Oh!....So una sef code wetin she wan do abi?
*Musa* : Haba!....are we a Shildren!.....we know wetin the babe want nah... Shebi she talk say cold dey catch her...
*Kizito* : Nigga, but you know I don't do shit nah....I no fit do that kind thing.... I'm not made that way....
*Eze* : Thunder fire you Kizi!....Incomplete and toothless bull dog!.....person wey see you for outside nah go feel say na you flex pass....ordinary free kick like this, you no fit play....
*Kizito* : Ehn!.....Well done....Pogba!....Free kick was designed for you not me....I no even know why this bustard go give am address....
*Dele* : You be fool Kizi....I no give am address... She bin follow me come back house yesterday....Nah she prepare that Egusi soup wey you destroy yesterday.... You think say me go calm down put meat inside soup?
*Eze* : Ehen!....I for say because I know say Dele Papa deg work for ESWAMA....Government never pay them for 3 months now...
*Dele* : 😒... Guy, you go calm down dey insult my P man oh....
*Kizito* : Dele, you mean say Sophia come this house yesterday come cook for guys...
*Dele* : I dey tell you.... She even replace bathing soap wey don finish....
*Musa* : Ogbeni, how she take know say bathing soap don finish....wetin carry am go bathroom?
*Dele* : Nah she wash toilet and bathroom yesterday....
*Kizito* : Jesus!....You let am enter our toilet?.....Oya kill me let me die.. You have destroy my reputation....
*Dele* : Guy, I no know how oh....I bin dey chow when she just comot go buy one pack of Eva, buy dettol, buy harpic, before you know it She employ herself as cleaner oh....I never saw it coming bro....
*Eze* : Shit!....Brother, that girl nah wife material....
*Musa* : 100 yards!!....
*Kizito* : guy, I still dey shocked oh....
*Eze* : Mumu, where your manners?.... Calm the babe and appreciate her.....Tell her that Dele has told you everything she did...
*Kizito* : You know she's still vexing that I didn't let her Come over...
*Eze* : your cross man!...Sha just appreciate am for me!....(Stands up to go to the toilet)....Now I can shit in a conducive environment....
*Musa* : Nigga, abeg shit with love, compassion and conscience abeg..... No destroy the landscape....
*Eze* : ( smiles).... I'll try my best....
*Kizito* : (softly, almost inaudibly)..... Shit!....what do you want Sophia?....
********†**********†********
Room 317 Alvan hall.....
*6: 00 Am*
*Stanley* : Oga Emeka, Oga Emeka..... Wake up, wake up...
*Emeka* : Ehn, princess.... Where is the yam?....(stretching, still in sleepy state)....
*Stanley* : Ehn.. Who be princess.... Na wa oh...you Still dey beg food for dream....
*Chika* : Oga Emeka case dey Critical..... Nah 3% battery be him case...
*CJ* : Guys, who dey go airport.... I wan reach there oh...
*Stanley* : Wait for me, make I put bucket for line downstairs.. Make two of us follow go deliver the cargo.. 😀
*Louis* : CJ, If you dey go, wake me abeg....
*CJ* : OK, make Stanley go out bucket for line come back....so how far your babe yesterday?
*Louis* : Make sense....
*CJ* : So how much you spend yesterday?
*Louis* like #2,000
*CJ* : Very good, see wetin sleep dey cause, if to say you no dey sleep nah, you for lie say nab just Tom Tom una buy for Chitis....
*Stanley* ; CJ, how far, I don put the bucket....make we go discharge...
*CJ* : Louis, Louis...
*Louis* : Ehhnnn.....
*CJ* We don dey go oh...
*Stanley* : you get paper?
*CJ* : E get one indomie carton wey dey outside....
*Stanley* : Jesus!...Carton!...you be iron man?.....make I go find paper
*Emeka* : (Stretches and yawn)....what is a the time? so Stanley, you didn't wake me again?
*Stanley* (turns to CJ)
*CJ* (turns to Stanley)
*Both* Oga princess.... Good morning Oh.....
*WRITTEN AND DIRECTED BY*
*#EJIOFOR KINGSLEY*
...
Comments
Post a Comment
Disclaimer: Comments And Opinions On Any Part Of This Website Are Opinions Of The Writers Or Anonymous Persons And They Do Not Represent The Opinions Of joelxclusive.com.ng
Pictures and culled stories posted on this site will be given due credit and is not the fault of joelxclusive.com.ng if they are given original credit from website Taken from.
If you have a complaint or a story,Please Contact joelxclusive
joelxclusive@gmail.com
Mobile Phone +2347036041666